![]() |
firstclassnewsline.net |
never start the main toasting sef, she don begin demand for money and
recharge cards. If na the tactics wey una dey use drive away guys wey
wan toast una or wey dey pester una, then una never start. Better
thunder is warming up to fire some people.
You go see babe wey dey form fine girl for Facebook, she go dey ignore
and snub people greetings like say like say. Maybe she get finance
problems or maybe she just wan drive away one guy wey don dey send her
greetings since 2012. So one day, the guy greet the girl and she
reply. O boy, before the guy go finish dey happy unto say this babe
finally respond to him greetings dem, the babe reply go be "I'm not
okay". The guy go ask wetin be the problem, the babe go say she need
50k to settle some school and family issues. play play, the guy go
transfer 100k give this babe. This fine girl wey dey form Miss World
go come demand for the guy fone number, unto say she wan form
appreciative na. As she and the guy come dey chat frequently and come
dey call each other for phone everyday, the babe go come find out say
this bobo is very funny, caring, understanding, intelligent and
handsome. For her mind, God don butter her bread. Una dey see this
babe ba?
As the babe come learn say the guy na one big contractor wey dey live
for Asokoro for Abuja, the babe go come introduce the guy to her
mother, father, siblings, cousins, grandparents, village people e.t.c.
for the babe mind, she don get husband oo. But for the guy mind, if no
be that 100k wey him give her, she for no dey follow am shine teeth.
For the guy mind, na to chop waka. Una go blame the guy? Finally, the
guy go come invite the girl come Abuja. Una trust Naija babes na, the
first thing wey go comot from their mouth na "I don't have transport".
Since Airport no dey (let say) Anambra state, the guy go wire 50k
enter the girl account, make she transport go Enugu go enter aeroplane
to Abuja. After she don withdraw the money finish, the thief thief
babe go remind the guy say 'God is Good' transport company dey from
Anambra to Abuja. Say she dey fear aeroplane. Imagine? The guy go come
persuade am make she just get mind enter aeroplane.
As the girl enter aeroplane for her first time land enter Abuja, na so
the guy go treat the babe like Queen. That night, them go go shopping
and cinema. Them go even eat for restaurant unto say the guy no wan
stress the babe, make she prepare food. Hmmmm, that night the guy go
drink burantashi dey wait for work na. During sex, the guy go demand
for blowjob. Na this same blowjob wey she no wan give her ex-boyfriend
wey make dem break up oo. But unto say she don see fine house and
money, she is even ready to suck and swallow sef. As the guy perform
well well that night unto burantashi things na, this babe go come dey
reason say God don finally answer her 'New Year' prayer. Unto say the
guy na complete package. Chai. She is just starting.
After all the jolly and sweet sweet sex (according to her), she go
come return to her base for Anambra state. Few days later, she go come
notice say her guy attitude don change. She go go ask why, the guy go
say him invest 20Million for one project so, and him money dey stuck.
Eyaaa, she go start to pity the guy, but she no know say the guy dey
target another babe. Just imagine this: her mumu friends go advise her
make she travel go see her bf, say him dey miss sex. Wetin una expect?
Naija babes feel say na only sex dem fit give for relationships na.
This babe go come hala her guy say she wan show Abuja, say she know
say him dey miss her. As the guy no want make the babe show, him go
tell her say him no get money to give her for transport unto him
20Million investment parol. Instead of this babe to use her head, save
the small money wey she don collect from this guy....this babe go fly
aeroplane land Abuja. Go garki market, cook foods store for fridge,
even use her money carry the guy go cinema unto to cheer am up. Chai,
for the girl mind she dey invest for the relationship. I no fit laugh.
As the girl dey prepare to return to her base, she go assure the guy
say God go fight their battle. Which battle? Shey you no wan use your
head abi? This babe go even ma count 10k give the guy, make the guy
use take care of himself. The guy go reject unto say him no dey lack
anything, na just skills him wan use pursue the babe. The guy go just
kukuma collect the money na.
Immediately the babe go back to Anambra, na im she go receive one of
the biggest shockers of her life. The guy go just call her, tell am
say it is over. Say na because she enter him life, that's why things
no dey work out for am again. Kai, some guys can be wicked oo. Mehn,
the babe go cry taya, come facebook come dey tell us how Men take
worse pass devil. My sister, if I catch you, if it catch you ehn...
See ba, if you reason am for your head say demanding money go drive
guys from you, you are still a big learner. No be for port-harcourt
wey Ikwerre Boys go buy motor for person wife just to sleep with her?
If you think say I dey lie, ask port-harcourt people first. Some guys
can fit give babes 2Million naira sef, dem plenty for Facebook. Them
dey derive joy in 'conquering' and having sex with babes wey too dey
form for here. Some babes dey purposely ignore person greetings, dem
go dey form wetin I no know. It doesn't hurt to just reply greetings
once in a week, we know say una inbox dey full with messages, but e no
mean jare. Dem go come Facebook dey form Queen Elizabeth. Who you be
sef? Common, bounce joor. Na Asokoro Boys go treat your fuck up.
Am not saying asking for money or recharge cards from guys is bad, but
demanding from people you barely chat with doesn't make sense. We no
know you, we no know your surname (most names here na pure fake), we
no know where you dey live, you no dey chat with us, but you wan come
collect abi? Some Naija babes can fall hand ehn, I taya.
Firtsclassnewsline.net
No comments:
Post a Comment
To get the world and your friends informed.. Feel free to share every news you read on this site on any web or on any social network by clicking on the SHARE BUTTON ABOVE or share it by any other means but ensure to always share with the site link(web address) for reference and to avoid being SUED for intellectual theft.......post a comment after reading as well..,...we are here to serve you the best
use anonymous to post a comment if necessary